Wednesday, March 9, 2016

I SEE PEPPER BEFORE I FIT BORN MY PIKIN - RONKE (OSHODI OKE) OJO

MISS SIMPLICITY - D veteran actress dey hapi like ant wey fall inside sugar yesterday on top sey her pikin don reach 3yrs. D actress com dey tell pipu sey no be small pepper enta her eyes o before she fit take born her pikin. She marry Anthony Gbolahan on Jan. 7th, 2009 bt she no see pikin born for many yrs nd bcos of dat pipu yeye her, dem call her witch, give her name wey mama nd papa no give her. Bt now she dey tell pipu sey make dem no give up o, make dem no let anybody run dem down, she tok sey na d same pipu wey dey yeye her dat time na dem dey hapi her now. Hmmmm......True tok, if Baba God don say yes abeg who dem born well wey go say no???

No comments: