NFF don call Samson Sasha again make he come be we coach for Super Eagles. E no too tey after Sunday Oliseh polongo say he no do again, na him dem halla the Bros wey be coach for the Dream Team VI, and na we
U20 coach, Emmanuel Amuneke plus Salisu Yusuf and Alloy Agu go dey assist am for the double match wey we get next month again Egypt for Africa Cup of Nations. NFF technical committee chairmo Chris Green say the coaching crew go work under the office of the NFF Technical Director Shaibu Amodu for the match. Na still dis same Siasia go still coach we Dream Team VI to the 2016 Olympic Games for Rio de Janeiro later in the year. Na so life reach, when one person spoil... Another man own go good. We say congratulobia to Siasia and him goons.
Saturday, February 27, 2016
NA SO LIFE REACH... NFF DON CALL SIASIA BACK AS EAGLES COACH
Subscribe to:
Post Comments (Atom)

No comments:
Post a Comment