No be small mata O. Na everybody like levelz one kain one kain, na him turn all radio stations for Naija to corporate beggars with different styles O. The award wey go happen dis coming Saturday, 27th of February for Abuja na him dey ginger all we radio stations wey dem don nominate for different categories, as stations dey beg, na so we Presenters dey beg. Na everybody dey send SMS, dey send BC, dey design artwork, wey dem tell dey do abeg. And na tomorrow wey be 23rd February na him the voting dey end and abeg if you no ever vote for presenter abi station wey you like, make you sharperly do am now. But pipu can beg sha.... One vote na just 50 Naira. One Bros say the award be like directory say na everybody dem nominate. Lol!
No comments:
Post a Comment