Thursday, June 16, 2016

CHAIII... ACCIDENT FOR ISOLO LAGOS, KPAIN KEKE RIDER AND HIM PASSANGER

Kasala burst for Randuck Filling Station area for Oke-Afa, Isolo, Lagos, when one keke Napep rider go jam fuel tanker on Wednesday. The man plus one passenger wey dey for front seat kpain instanta when the 2 others wey dey back woundjure no be small and dem still dey for critical conditions for the Isolo General Hospital, Isolo. Tori say the number 4 passenger wet carry small injury, dem don free am from hospital. One person wey dey there see am, Jibola Oladokun, say na over rush wey the keke rider dey do, na him cause the accident.

No comments: