Shebi na time wey no too tey I yarn una say Police for Sango division, Ibadan don catch some student leaders for UI, and the students dey claim say na UI Vice Chancellor, Prof. Idowu Olayinka na him say make police catch dem, even BB write am for him Facebook page wey be Asiwaju Babatunde Badmus, but for time wey no too tey na him BB share some pinshures for him facet page again say Police don free dem. Dem even put pinshure wey dey snap with Mama Sango, wey be Deputy Commissioner of Police plus DPO for Sango Police Station but we never sabi how dem come later settle am. But koko be say dem don free dem. (see anoda FOTO under)
No comments:
Post a Comment