Saturday, February 27, 2016

PHILIPPINES SAY DEM FIT NO ALLOW MAMA MADONNA ENTER DEM COUNTRY AGAIN O!

MISS SIMPLICITY- As e dey hot: d Philippines govt don tok sey dem fit ban Madonna from entering dia country again...Tori get am sey the singer don march the face of of dem laws for Philippines during one of her concert wey happen on Wednesday Feb 24th nd Thursday Feb 25th wen she use dia flag as costume 4 d concert for Manilla nd tori tok sey no b d first time wey she go do sumtin like dat. She  don first do am for China dis month wey she use d Taiwan flag do costume too nd d Chinese pple no happy as dey see am as insult on their province. Make we see hw e dey go as she get anoda show 4 Singapore on Monday Feb 29th, she fit break anoda record for there too...Na wa for dis Old Mama youngy

No comments: