Friday, November 28, 2014

CHAI....BOKO BOYS THROW BOMB TAKE KPAIN 5 SOLDIERS AND 3O CIVILIANS FOR MUBI


5 Soldiers plus 30 pipu na him tori yarn us say dem die wen Boko Boys
go throe bomb for Mararaba-Mubi area wey dey Adamawa State on
Thursday. The bad thing shele when hunters plus military men go follow
Boko Boys do gbege for Mubi.
Pipu wey see am wuth dem korokoro eyes yarn news pipu for Yola, the
state capital say na combined team of the military plus local hunters
dey on dem normal patrol when the bomb wey dem don arrange for the
road side blow and he kpain we better pipu.

No comments: