Friday, February 26, 2016

YORUBA PIPU SHARP BUT DEM NO GET BRAIN ... KEMI OLUNLOYO DEY YAB ON TOP OLAJUMOKE MATA

I don personally taya for dis woman abi na babe,  wey just dey form Badoo for Naija dey talk anyhow anytime she get chance. Kemi Olunloyo don come again with her bad mouth when she dey yarn say TY Bello no try at all for Olajumoke,  say dem just dey use here head make money ni, say dem don turn Olajumoke husband to driver,  as per say na him dey carry pikin for plenty pinshure. She say Olajumoke no be role model and she no even be icon as she no fit speak Oyinbo,  she no even finish primary school. She still yab one South African bank wey dey celebrate Olajumoke,  she say why dem no go find person wey dey sell bread for dem country. When she wan come spoil everything,  she say many yoruba pipu dey sharp,  but dem no dey get brain. Kemi and her bad mouth nobody for dis one for my side at all. Why she dey vex, wetin concern her?

No comments: