Takulah...make una fear God o...na so the chairman of
Labour congress for Naija, Comrade Muyiwa Olojede dey shout o. He say na lie
Gov Ajimobi lie for dem head o say dem don follow am do meeting and gree say
make he reduce salary of workers for Oyo State.
Make we no forget say na on Saturday the Governor yarn that when he dey on Voices with Edmund Obilor for Splash Fm on saturday. NLC say true true dem follow am do meeting but sha o dem no remember say dem gree with am say make dem reduce salary. He say na how state government wan take pay the gbese wey dem dey chop na him dem discuss. He come warn o, say make dem no even reason am at all at all o, cos he no get where dem wan carry am pass wey dem go gree make dem cut workers salary.
But when Splash FM replay the interview today on top dem programme Bull'e Eye, me no hear where Governor for talk am say NLC don gree make him cut workers salary. Our pipu sha.
No comments:
Post a Comment