Friday, February 26, 2016

OYINBO DON PUT FORMER GIRL WEY FINE PASS FOR NAIJA AND HER HUSBAND FOR PRISON ON TOP WAYO

This oyinbo pipu dey worry O, dem no even dey look face at all. Na so tori enter we dommot say the babe wey dem sama crown say na she fine pass for Naija in1992, Sandra Petgrave plus
her husband, George Chukwuka, na dem Oyinbo don put for prison don dey Oyinbo prison for United State of America. Dem say the couple do jibing wayo of $5.8 million on top buy house mata wey Oyinbo dey call mortgage and na like 5 years dem take do the Parole,  Dat one na between 2006 and 2011. FBI even talk say na Chiedu na him be dem leader dat year,  Dat na why dem sama Sandra I and handle year and dem give chiefo 9years. We still hear say dem get 6 pikin together.

No comments: