Monday, February 22, 2016

SWEET FM FOR ABEOKUTA DON CARRY MC CODED FROM RAY POWER IBADAN

Who no like beta thing make I hear,  as Radio station dey open everywhere for South West Naija na so the competition dey high everyday wey stations dey move Presenters from other stations. Na so I just realize for some time now say MC CODED wey him real name na Victor Mark Eniola, one of top 10 OAP'S for Ibadan last year according to one blog IB City Rocks, don Waka commot from Ray Power wey dey Ibadan. Coded don codedly move go Sweet FM 101.7fm for Abeokuta. Na former Senator Obadara get am and na 1st of February dem start to dey polongo. And from the Aproko wey I dey hear he be like say na one kain big Oga position dem put coded. We for TPN say congratulobia to the coded guy.

No comments: