Monday, February 22, 2016

NA WHEN OLAJUMOKE DEY LEARN HAIRDRESSING, SUNDAY GIVE AM BELLE- MAMA ORISAGUNA

Na Nigerian Tribune go Iree go interview Olajumoke pipu,  and make I cut dem salute cos dem do well. Dem interview her Mama, her  Mama brother,  her husband mama plus her husband brother. Na there the Mama yarn dem how Olajumolrtalk say she no go school again after primary school say she wan learn hair dressing ni. The Mama wey dey sell vegetable for Iree even show dem Olajumoke 'funny' salon. The mama of her husband na him come explain how her son take give am Belle when she dey learn hair dressing and how she take accept dem. All of dem just dey happy dey advice her make she calm down and make she no disrespect pipu wey help am.

No comments: