Monday, February 22, 2016

MAN AND WOMAN GUM TOGETHER FOR WHERE DEM DEY RUN PACKAGE FOR KENYA

Dis one no be Nollywood O,  e no even happen for Naija but for Kenya where pipu come out come see one man and woman wey don gum together where dem for dey chop yam. Na only God know wetin dem don try wey no work before dem drag dem self come out make pipu save dem. Tori from Kenya from one Mr. Rich, na him throway the pinshure on top facebook, say the man wey come from the Kitale na him God catch when he go chop him neighbor yam behind him back. Dem say as at the time wey dem dey write the tori dem still dey gum together forgether. Make God save persin from longthroat.

No comments: