Tuesday, February 23, 2016

SEE AS GOD DEY WORK, BUHARI APPOINT BLIND MAN AS HIM SENIOR SPECIAL ASSISTANT

President Buhari don polongo one man wey no dey see, Dr. Samuel Inalegwu Ode Ankeli as him Senior Special Assistant on matters wey concern disabled people. Na Senior Special Assistant to Buhari on top Media and Publicity, Shehu Garba, na him polongo for statement wey he release yesterday Feb. 22nd. Shehu say na Ankeli be the Oga for pipu wey get disability for Buhari/Osinbajo APC Presidential Campaign Headquarters and na dem be the first of dat kain department for political party for Naija. "Dr Ankeli na from Benue State. He go school for Giwa, near Zaria plus Kaduna before he go study veterinary medicine for ABU Zaria. Toor.... We for TPN say congratulobia Oga.

No comments: