![](https://blogger.googleusercontent.com/img/b/R29vZ2xl/AVvXsEjvSm5GkztpfoLTNTr9tJJoQ0S0GWD4ylS7IFpNg9-NgW9D67AIgZQJ7ORpKMaHuQxxFFdBRxej7kD6Ai6cArRhdB1nrEDFzsiysQh-UQY0ONONq5l38a48iUBMsqKrZ8WZGxsR09T2Zqk/s1600-r/HEADER.jpg)
Wednesday, October 21, 2015
HON. DAPO LAM DEY GO REPRESENT NAIJA FOR SWEDEN
Hon. Dapo Lam a.k.a. Omo Oloore wey dey rep Oyo state for Federal House of Rep na one of the pipu wey Swedish Embassy for Naija don select make dem come visit dem country as dem believe say dat kain arrangement go make future collabo between Naija and dem country dey possible. The mata we hear say go she from October 23 to 25. Pipu wey dey go represent Naija go meet. Swedish Parliament, Swedish Association of Local Authorities and Regions, The Swedish Agency for Youth and Civil Societies plus including Swedish Tax Agency. Other Naija pipu wey go follow Hon Dapo Lam do the waka na, Rosemary Ajuka wey be OAP for Cool FM, Alkasim Muhammad Zangina plus including the Executive Director for The Initiative for Equal Right (TIER) Olumide Femi Makanjuola plus including others. Dapo we say weldone shogbo.
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment