Miss Simplicity - Clarion Chukwurah wey bin don marry two husbands before nd wey born Clarence wey be ogbonge producer for our very Sir Shina Peters naim tori dey yarn us sey she don kawasaka comot for d church wey she dey go before enta Jehovah's Witnesses afta she marry her third husband Anthony Boyd wey be one of Jehovah's Witnesses for March dis yr o..
D actress naim nack media wit pinshures wey she nd her man take afta dem finish meeting for kingdom hall o...
She tok sey she dey on d way to baptism nd to begin dey do d work wey Jesus give dem before him ascend go heaven o...
Correct tori wey totori my body as I see ham, ma'am carry go Baba God dey ur side....
See d anoda pinshure afta d cut...
Wednesday, July 13, 2016
CLARION CHUKWURAH DON CHANGE POSITION ON TOP RELIGION MATA.....
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment