Wednesday, October 14, 2015

AFOUDA GO RELEASE HIM SONG " I BELIEVE IN NAIJA" ONLINE FOR HIM BYDAY ON 15TH OCTOBER

As all of una suppose don know say my byday na tomorrow, October 15. I don ready to throway one song like dat wey I record in 2012 online make I dash everybody, make dem chop am as my byday cake. Many pipu no even know say I dey sing, so make he be surprise plus including shock. The song follow the style of my byday mate, Fela Anikulapo kuti and e go surprise you say Afouda Baba Agbalagba no dey carry last for anything. Na Mr. Etang produce dat song for me in 2012. He sweet die, before nko? Wetin I for talk, no be me sing am....lol. Expect am tomorrow.

No comments: