Friday, September 11, 2015

INA LILAHI...5 NAIJA PIKIN DON KPAIN FOR GOD DOMMOT FOR HAJJ

Ina lilahi wahina ilaehi rajihuna......Tori wey dey land we dommot from Mecca be say 5 of we pikin wey go hail Baba God for this year hajj don kpef for him dommot. According to the persin wey lead Naija pipu go, Bello Tambuwal, he say na for Mecca 1 of dem kpain and one other person kpain for Medinna. But sha dem don arrange clinic for we pipu wey still dey there. May God sama dem better heaven.

No comments: