Tuesday, February 23, 2016

THIS SUNDAY NO GO EASY... PETERU WAN CARRY VEXNATION MAKE YOU LAFF WITH PETERU UNLEASHED

If you no dey town dis Sunday,  you fit get excuse,  but if you dey town,  you no come go.... Walahitalahi you don miss. The most popular comedian for Ibadan wey don still be OAP with Naija FM, PETERU don vex. If you wan see as he vex reach,  look him face for the art work. The vexnation no be to fight sha,  na to make una laff scatter dis coming Sunday, the 28th of February for Mauve 21 Event Center wey dey Ring Road. No be only PETERU go dey there O, some other beta comedians for Naija go follow am run the package, Dr. Frick, Arole and Co go dey represent Ibadan and others like Bash, Seyi Law, Omo Baba,  First Born go dey. Daddies like Ali Baba, GbĂ©nga Adeyinka plus Teju Baby Face go show specially and for music, Ibile guy Kesh, Pizzy plus plenty others go dey. My Pipu the show go too tuff,  no miss am. Check the pinshure wey dey up for more info. Meanwhile PETERU byday na dis Friday 26th and cells go dey play match for Adamasibgba,  the ball na against domestic violence.

No comments: