Tuesday, February 23, 2016

HURRAY... FEMI ADEBAYO "JELILI" DON BECOME SPECIAL ADVISER TO KWARA STATE GOVERNOR

No be small happy na him Nollywood actor Femi Adebayo dey happy now O,  as dem don polongo say him be Special Assistant on Culture and Tourism to Kwara State Governor, Abdulfatah Ahmed . Na yesterday the Bros climb on top Instagram to yarn him fans as e dey go say dem don appoint am as Special Assistant( SA) to the Kwara State Governor, on Arts, Culture dem give am opportunity to transform my state. He come veg him fans say abeg make dem no leave am O. Naso Bros too take style become politician O, and na for tome wey no too tey na him dem appoint Ini Edo as Special Adviser on Tourism to Akwa Ibom state by dem executive governor, Emmanuel Udoh , and Kate Henshaw dem appoint her too as  Special ADVISER for Liason, Lagos by Cross Rivers State governor, Ben Ayade . Na my own remain.

No comments: