Tuesday, November 24, 2015

LAGELU FM DON VEX, AS DEM DEY PLAN ROADSHOW DIS SATURDAY 28TH NOVEMBER

Lagelu 96.3 FM don vex, enter we backyard with full force. The hype don first dey like say na something else, but now wey dem don dey do Test Transmission for about 3 weeks abi 4 weeks now. Ibadan pipu don dey feel the station die with dem plenty presenters wey dem gather from all over Naija, including we Editor-in-Chief, Afouda Baba Agbalagba. Now dem don paint Ibadan with dem plenty bill boards wey dem take dey show the face of some of dem presenters. But the mata no end for there sha. Dem wan do Road Show on Saturday, the 28th of November and dem don dey loud am for dem station, say on Saturday, dem go waka, dey dance for road from Challenge to Molete, Molete to Bere, Ojaoba, Bus stop, Total Garden, UCH, Mokola Roundabout, Dugbe, Iyaganku, Akinyemi, Ring Road come go back to challenge and na 10am dem go start. So make una no dull o, make you commot go see the face of all dem OAP's wey una like.

No comments: