Wednesday, October 21, 2015
THE FINE GIRL FOR BCOS, DAMILOLA AYORINDE NA PLUS 1 TODAY
She fine die, she young gan and she sabi wella, her name na Damilola Ayorinde, see as God dey work o, na Law she go study for Leadcity University but na for Television she dey yarn on top BCOS. The babe get brain come still fine join, that na why dem Ogas for BCOS fit dey put am for AM120 programme where dem for dey talk brain and she no dey fall my hand anytime I watch am for Television, even God sabi say I dey like to watch am cos according to Mr 2kay, who no like beta thing? So today na her byday and we dey celebrate her specially for TPN. I believe say one day very soon, she go make us proud for international level...Happy Byday to you omo to she daadaa.
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment