Bcos of the gbege and kamala wey burst last Saturday for the election wey dem re-do for Rivers state, Ekiti state governor, Ayo Fayose don talk say Baba God dey vex for Buhari. Na yesterday, 22nd March, for Abuja, Fayose for yarn all dis when he dey follow news men yarn.
He say, nobody fit give man power, na God dey give am, he say for sake of say dem dey oppress pipu, dey bring pipu down, dey cut dem, dey take dem blood, say God dey vex. He say with how dis government dey run dem package, God dey vex, God no dey happy. He say if you go Rivers, go Akwa-Ibom, go Bayelsa... Na so so kill dem dey kill innocent pipu. He say God dey vex for Buhari. He say everything wey he talk say go happen for dis year 2016 for Naija don happen. He some sleep dem doubt say person wey go first take am, go first take God, say if na all dis kain gbege shele after general election ni, shey Buhari go become Presido?
No comments:
Post a Comment