Friday, September 11, 2015

PIPU WEY BUHARI GO POLONGO AS MINISTERS GO SHOCK UNA LIKE ELECTRIC

Toor....dem say make all of us hold our body strong o, cos we go shock wen we hear name of pipu wey go dey on top Buhari list wey we dey expect. Tori yarn us say dem be tear rubber pipu wey get better brain and go fit deliver, say like 4 former governors wey don dey reason am say dem go dey on top the list don jented cos dem go wait till dem become waiter. If na tear rubber persin wey get brain, make una no too shock if una hear my name o...lol

No comments: