Friday, February 26, 2016

COURT SAY MAKE DEM GO HANG MAN DIE BCOS HE THIEF 100K JEWELLERIES

Thiefery no good O.  Na so court yarn say make dem go hang one man, Friday James, and no be say dem go hang am small O,  dem go hang am till he kpef on top say he carry weapon go thief wey Oyinbo dey call armed robbery. Tori say James go rob one Olanrewaju Jumoke's,  collect her jewelleries wey be like N100, 000 on February 17, 2012 around 3:00 a.m. for Ewegbemi Street, Meiran. He even woundjure the head and hand of the woman husband as per say he get gun and get cutlass. Dem say wetin he do according to we Police dey against Section 297 Criminal law of Lagos State 2011. Na so Justice Oluwatoyin Ipaye wey dey one Ikeja High Court say na true the guy do am, come say make dem go hang the guy die. Tori yarn us say that same court on February 17, 2016 still throw 2 guys, Omoilodan Seun plus Gbenga Kayode to prison say make dem go kill dem cos say dem rob too.

No comments: