Friday, February 26, 2016

CHAIII... TSUNAMI DON CARRY 97 STUDENTS FOR UI

The University of Ibadan don pursue 97 students on top say dem no sabi book at all. Tori yarn us say the students no get wetin dem suppose get by the time wey dem finish the 2015/16 academic session. For one statement wey dem throway by Registrar for the school, Olujimi Olukoya, he say 3 of the students na him Waka commot for dem self by dem self and the others dey for different levels for seven different faculties,  even final year student dey among dem. Na the Senate for dem  meeting on Monday, February 1, 2016, confirm the level O,  say make the students dey go back home cos dem brain no fit carry Ui. All those ones dey join as dem don polongo say na Ui be number 1 for Naija,  wey University of Lagos come follow.

No comments: