At times I dey confuse, why we just like to dey lie wey no dey necessary, shebi una Sabi Emmanuella, the small funny girl wey dey do comedy skit. Na so I hear say the girl go scatter dem Belle for Funnybone show last Sunday. Tori yarn us say she take Bovi catch cruise well well before she move to Olajumoke and TY Bello. No be Dat one cos gbege O, na THE report wey talk say the girl never pass 5 years. Na him my pipu press P, say why dem dey lie for the girl age na. Some even carry science prove am say pikin teeth dey commot when e dey between 5 and 7, so she fit be, but some no gree O, dem say na lie the girl go dey Dat kain 9 or 10. Abeg wetin you believe?

No comments:
Post a Comment