Shebi na sometimes last week Tony Payne do one interview for Inspiration FM wey dey Lagos, where she for talk say na Adekunle Ayeni, wey get www.thenet.ng plus Black House Media, scatter him marriage to 9ice. She say Dat time na Ayeni The Great be megaphone for 9ice and she tell am Dat time make dem stop the yeye rumour wey dey smell for her body say she dey chop yam with Rugged man for back but bcos say Ayeni wan take the news sell him magazine, he no gree do the right thing. She even say Ayeni na her enemy. But Sha O, 9ice for interview wey he do with punch don clear say no be so O. He say Ayeni just dey do wetin he ask am make he do Dat time ni, he no get hand for how devil take scatter dem marriage. He come still beg him wife before, make she forgive am for all him mistakes.
No comments:
Post a Comment