Toor, if you join pipu wey dey Halla #wakawakaBuhari on top Twitter, make you never log out O, bcos President Buhari still dey travel today, 22nd Feb, go Saudi Arabia. Na the Special Assistant to President Buhari on Media and Publicity, Femi Adesina yarn say presido and him Padis like Minister of State (Petroleum) plus
GMD for NNPC, Dr. Ibe Kachikwu, go first go Riyadyh go see King Salman Bin Abdulaziz Al Saud plus senior officials for the Kingdom of
Saudi Arabia. Dem go talk about oil money wey dey fall. Na Doha dem go Waka go on Saturday go yarn with Emir for Qatar, Sheikh Tamil bin Hamad Al Thani. Buhari go still meet businessmen for Riyadh and Doha, scope dem make dem come do business for Naija. Baba go come finally go Mecca/Medina go pray for Naija. Toor, we for TPN say Safe Journey Sai Baba.
Monday, February 22, 2016
ALUTA CONTINUA... BUHARI NEVA TRAVEL FINISH AS HE DEY GO SAUDI TODAY
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment