Sports Writers Association of Nigeria (SWAN) don vex talk say we Super Eagles coach Sunday Oliseh na confirm liar who no get shame at all, say na everything he dey find excuse take cover up as he no Sabi anything for coaching mata, dem say apart from say he no Sabi, he still no get beta character wey fit make am super Eagles coach. All dis Para mode na after the 7 days wey dem give am make he mention pipu wey come meet am for money. Oliseh bin don talk say some writers come meet am make he Roger dem, so dem go fit dey write beta things about am. SWAN say na so NFF and dem workers come dey look dem like gonna be cos of wetin he yarn, so as he no gree mention names now dem say he don show give the full world say na lie he dey lie give Naija pipu, na Sabi wey he no Sabi nada dey worry am.
No comments:
Post a Comment