Friday, November 28, 2014

HE DEY CARRY THE JOHN THOMAS OF WE CONSTITUTION PLAY SO HE MUST GO- OGA LAWYERS DEY PARA


Dem APC plus some plenty better Oga Lawyer for Naija like Olisa
Agbakoba, Yusuf Ali plus Niyi Akintola, don dey halla o, say na must
o, dem gats commot the Oga Olopa for Naija, IGP Suleiman Abba, on top
say he still dey do strong head say him no dey recognize Alhaji Aminu
Tambuwal as the  Oga Speaker for we House of Representatives. The APC
for one statement wey dem Megaphone, Alhaji Lai Mohammed write say
Abba don show say him na proper politician and that one don show us
say he no go fit do well wen election show face next year cos say he
go too do ojoro.
All dem Oga Lawyers too dey talk say if no be say Sule no sabi maths
how him go talk say he no fit recognize Tambuwal who dem elect normal
normal by the 360 pipu wey be members of we House of Representatives,
dem say wetin he dey do just be like say he dey carry the John Thomas
of we Constitution dey play for market.

No comments: