Friday, November 28, 2014

THANK GOD WE FIT KPAIN 30 BOKO BOYS FOR BORNO


Na like 30 Boko Boys we civilian Joint Task Force (JTF) fall on
Thursday wen dem dey plan to go do dem strong thing for Gubio Local
Government Area of Borno State. But sha o, like 5 of we JTF members
too woundjure for the mata, but we thank God cos none of dem kpain.
Tori yarn us say na Hilux plus Okada wey dem baff up with Ak47 rifles,
locally made bombs plus petrol bombs na him dey carry plenty go hide
near Kareto, and na for there some pipu wey get better eyes shadow dem
wey dem go do ofofo for the youths wey dey Gubio and Kateto. Na so the
better youths wey get mind go hayaj dem for where dem dey hide and na
for there dem kpain 30 of dem.

No comments: