Dem Oga for APC don dey threaten we preside say whether he like am or
not dem go commot am for office next year. Those Oga na Oga Muhammadu
Buhari, Jagaban himself Bola Tinubu; Baba Bisi Akande plus all of dem
State Governors, all of dem say dem don show as Messiah to rescue
Naija from Uncle Jona hand in 2015.
Na for Oshogbo dem dey yarn wen dem dey do parry for the second-term
inauguration of Governor Rauf Aregbesola. The Oga Chief Judge for Osun
State, Justice Oyebola Ojo, na him swear for Ogbeni Aregbesola plus
him deputy, Mrs. Titi Laoye-Tomori.
No comments:
Post a Comment