By EMMANUEL CHIKA & BY ADETUNJI ADEKUNLE ROTIMI (HAYKAY)
As different things dey happen for this life wey we gather dey, na him make one bad things happen for our entertainment industry wey make person cry till water commot for him eye, but thank Godfor him prophet wey he dey use. This time na Ochara brand new prophet God use take wipe away tears from the eyes of my fellow Naija pipu.
I believe say all of una go remember one Mr soul E wey sing Soul E baba, and do collabo with 2 !aba for e be like say, but now the bros don talk am say Baba God don dial him number and him don turn prophet o, make im com dey bless pipu and to dey prophesy.
According to Soul E Baba, him first revelation wey baba God show am wey him com later put on top him facebook account. He talk say na 4 him sleep baba God open im eyes to see as dem bad bele pipu take
poison wizkid, and na 4 dat same sleep him see Davido(omo baba olowo) for serious motor accident, therefore he say dem need to dey very careful and prayerful cos aye pipu dey find dem.
But him don take care of the mata, don cancel am unto him level as per prophet wey him be. Make Wizzy and Davido go pay the bros prophet offering o.
1 comment:
LMAO
Post a Comment