BY EMMANUEL CHIKA
Una don see pesin wey neva use water wash body since 1954? Hmmmmmm!
Naso we c am ooooh! Na one smelly 80yrs old man, wey neva use water wash body for the past 60yrs, wey dem dey call AMOU-HADJI 4rm Iran.
The man no get house, he no dey gree chop beta food and he
no dey gree drink clean water sef. The food wey im sabi chop na porcupine wey
don die and im dey always smoke pipe wey put animal shit inside. Hadji talk say
im don make up him mind to dey live like this so that him and earth go dey
2geda and be pady. D last pesin wey stay make im no wash body na one indian man
wey dem dey call KAILASH SINGH, wey no use water wash body for 38yrs. As
hadji talk, im say d reason wey im take dey live diz yeye life na bcos im be
get emotional wahala wen im small, nd say to dey clean dey make am sick. na
4rm dat tym my padi start to dey im own.
No comments:
Post a Comment