Monday, March 24, 2014

CHAMPE QUARTER FINALS-NA SO E GO BE

BY ADETUNJI ADEKUNLE ROTIMI (HAYKAY)

Nigeria U17 3–0 Mexico U17:
Our personally personal Flamingoes of Naija finish Mexico babes wey play U17 cup. Na 3 - 0 be the scores. See serious sexy trashing. This one ne jara, now the main tory.

Manchester United go enter am with Bayern Munich. First leg go happen for Old Trafford wey be Manchester United home.

Chelsea and PSG go tear tear dem-sef for dis Champe Quarter Final. Na PSG go dey home for dis First leg.
Two La Liga side, FC Barcelona and Atletico Madrid wey dey use strong head for dem-sef on top La Liga Cup go separate men from boys. Na FC Barcelona dey home for dis Champe Quarter Final First Leg.

Real Madrid and Borussia Dortmund go show colour again for Champe Quarter-finals. E go wan be like repeat of last season Semi-final of which na Borussia Dortmund pursue Real Madrid comot. Na 4-3 on

aggregate dem take comot Real Madrid.

All the teams wey remain for dis Champe Quarter-Final get liver die. So, e go dey hard to predict say na one particular team go carry the Cup.


First leg go happen on April 1 or 2. Second leg go happen on April 8 or 9.


Na the draws be dis proper:
- Barcelona vs Atletico Madrid
- Real Madrid vs Borussia Dortmund
- Paris Saint-Germain vs Chelsea
- Manchester United vs Bayern Munich.

No comments: