Wednesday, March 26, 2014

WE SUPPOSE FIND PERMANENT SOLUTION TO STRIKE FOR THIS CONFAB-NANS



According to Gbadebo, who be NANS representatives wey dey the conference he say na to come present issues wey dey affect Nigerian students and youths in general. Dem say e no make sense o say poly students and students of college of education  dey wastehouse for almost eight months now as per say dem academic staff dey on strike.


So, dem say one of the things wey dem go yarn for the conference na to make sure say dem find lasting solution to the strikes wey dey shele every now and den for institutions of higher learning for Naija. He believe say dem go fit find dat solution for this confab.
 
Dem say den still wan present to the confab for endorsement the Nigeria Students Union Bill wey go ensure say student unionism for tertiary institutions dey compulsory.

No comments: