One association for Tiv pipu wey no dey
Naija, wey dey answer The Mutual Union of the Tiv in America, yarn on Wednesday
say e no make sense as Fulani pipu dey kill dem brodas wey dey naija o.
Dem warn o say if government no fit
defend Tiv people, they no go get choice pass make dem ginger dem swagger to
defend themselves o. The organisation, wey get members from United States,
Canada, Mexico plus including other countries, na dem dey react to the plenty
attack wey dey shelle for Tiv citizens wey dey Benue State and some communities
for Nasarawa State by pipu wey dem dey suspect say dem be Fulani herdsmen.
The
report say d one wey happen for time wey no too tey for Agena, one district
community for Mbalom wey dey Gwer Local Government for Benue State, on Tuesday,
na like 60 people those Fulani pipu massacre, and many of dem na children and
pregnant women
No comments:
Post a Comment