Our
beta pikin, who sabi book pass library, Prof. Wole Soyinka take presidential system of
government wey we dey practice for naija rob am yesterday , say na d system dey
breed corrupt leaders.
Prof
Soyinka, who dey among the panelists for the inaugural Public Service Debate wey
Saint John’s Forum arrange, and dem call am: Will Nigeria Be Better Served
By A Parliamentary System of Government?, yarn for lasgidi say even those wey we no elect under dis
present system go take agidi bulldoze dem way enter office.
Peolple
wey follow dey for the event, na former Minister of External Affairs, Mr. Odein
Ajumogobia, Deputy Senate President, Senator Ike Ekweremadu, who Prof Okechukwu
Okoh come represent, Dr. Abduraufu Mustapha also follow for the matter as
panelists, and na former Commonwealth Secretary General, Chief Emeka Anyaoku
moderate the problem
No comments:
Post a Comment