One delegate wey dey the National
Conference wey dey shele for abuja, Moshood Salvador, say he don go hire professors
o, make dem dey do research wey go make am fit work well for the conference.
He say the opinion say na big allowee
government dey pay dem no make sense, the mana who be former member for house
of reps, come even accuse him fellow delegates,
the Overseer
of the Latter Rain Assembly, Pastor Tunde Bakare; plus one former President of
the Nigeria Bar Association, Olisa Agbakoba, and human rights lawyer, Femi
Falana – say dem dey form dey show demselves say dem no dey collect allowance
wey dem dey pay dem for the confab.
Salvador say since dem start the
conference him don spend pass the N1.5m wey dem pay dem take employ aides and
researchers wey include professors, so he go fit do well for the confab.
No comments:
Post a Comment