Monday, March 24, 2014

TIV YOUTHS VS FULANI MERCENARIES………THE FIGHT STILL DEY HOT O!


Na like 55 pipu e be like say dem fall on Sunday afternoon for one of the hottest gbege wey don ever happen between Tiv Boys and Fulani mercenaries at Gbajimba, head quarters of Guma, Local Government Area of Benue State. Na this Gbajimba be the only community wey dem bin no touch out of like 200 communities wey siddon for Daudud that time wen den hayaj Gov. Gabriel Suswamwen he go hail dem for the area some weeks ago.


According to Tribune as at the time wey dem dey write this tory, gun still dey sound like rocket and women plus dempikin dey pick relay enter |markrdi, wey be dem state capital. Na this gbege dey follow the one wey dey follow the one wey dem take gbege Tse Orom-Adorogo, the home town of Oga Minister of State for trade and Investment, wey still dey supervise aviation ministry, Dr. Samuel Ortom. Dem say those Fulani mercenaries been wan hayaj Gbajimba for dem own dommot early momoon Sunday, but the TIV youths no gree dem, s dem show dem say dam no dey dull at all for them home.

No comments: