Oga Minister of State for Foreign Affairs, Dr. Nurudeen
Muhammad talk yesterday for one sensitization programme wey happen for Enugu.
The Minister yarn through the person wey represent am, Amb. John Ejinaka say na
the money wey dem make for this yeye business dem take dey sponsor terrorists
for West Africa.
He say this happen because dem don see say our borders no
tight, our surveillance na wash, our equipments na old school, our laws na
kuyinyin and everything wey we suppose take fight trafficking na ofutufete.
When the chairman for NDLEA open him book, he say na more than 68, 645 drug
traffickers na him den don arrest and dem don prosecute 16, 979of dem
between 2009 and 2013 (abeg
wetin dem do for the rest), he say different kind of drugs wey demdon
seize between 1990 and 2012 go dey weigh about 3million kilograms.
He come say with the way the mata dey go, na to introduce
drug education to primary and post-primary schools go make sense pass.
No comments:
Post a Comment