Serious politics and politrics dey go on presently among the
Ogas at the top for Naija Police,as per sayu dem present Oga, Inspector General,
Mohammed Abubakar dey retire by July. But some kain rumour wey dey fly around
now be say we presido, Uncle Jona dey reason am say make he extend the bros
tenure till after general election next year.
Na the rumour come make blood of pipu dey hot, especially
those wey don deysteady dey wait make the Oga commot for the sit make dem sit
down. Some Taafia for inside Nigerian Police wey gist newsmen say na pipiu wey
gbadun the IG dey hustle make presido push him stay forward, but all those ones
na under G runs, but pipou wey wan reign after him no dey hide dem own feelings
at all. Dem say especially one D.I.G. wey dem no gee mention him name, cos he
be like say the post too sure for the guy
But the Taafia say the mata go upgrade this week o, cos dem
wey be IG fans for inside the police don dey arrange some kain bad belle
transfer and ungodly promotion wey dem go unveil this week. So make we just
siddon enjoy the movie as e dey go, but if you go take my advice no do anyhpow
for a policeman this week o, cos he fit dey vex.
No comments:
Post a Comment