Office of we presido don talk am come pout o, say e no dey probe the
allegations of misappropriation of public funds wey dem take dey hayaj
Madam Minister for Petrol mata, Mrs. Diezani Alison-Madueke.
Na the Senior Special Assistant to President on top Public
Affairs, Dr. Doyin Okupe, yarn Saturday PUNCH on Friday, say Federal
Government no go set up probe panel to
investigate the mata o, bcos say House of Representatives don dey probe her
already.
Alison-Madueke na him dey dey challo
say she don spend N10bn on top jet wey she hire for two years now Challenger
850 and na on top the mata the house of reps dey gbege her.

No comments:
Post a Comment