Shuu…this one na devil wey dey form
angel o, Thirty nine-year-old Angela Chidozie, who police for Ogun State catch last
week Friday for one house where dem for dey produce dey sell pikin for Akute
Area na him report Say she dey while away life for the Anti-Human Trafficking
and Child Labour Unit of the command.
Report yarn us say the yellow sisi wey
dem arrest with like 8 young girls wey don chop bellefull, don get belle of
different sizes and shapes, na him yarn Saturday PUNCH say no be to make
money be the koko of her business o, cos she too dey sure say none of her
customers buy the baby to take do juju.
Wen dem ask am how she take know, she
xaid she dey study pipu before she sell market give dem o, and she dey make
sure say na pipu wey dey find pikin she dey follow run package.

No comments:
Post a Comment