Saturday, March 29, 2014

DELEGATES FOR CONFAB WAN COMMOT IMMUNITY CLAUSE O



Delegates for the National Conference wey dey shele for Abuja fit vote say make dem remove immunity clause commot from our constitution o, if wetin dem dey talk fit come true.


Investigation wey Saturday PUNCH do na him show say pipu wey dey want make dem adjust Section 308 for our Constitution, the one wey make our President and state governors untouchable and uncatchable, don start dem moves to make sure say the proposal make brain.

Saturday Punch  say those pipu don already start dey yarn other delegates as per how dem go take get the necessary voye to delete that section commot frpom naija’s constitution..

No comments: