Na
Villarreal striker, Ikechukwu Uche head dem take break coconut yesterday for the
Tom Tom Media Roundtable with Super Eagles coach, Stephen Okechukwu Keshi. We
go remember say Uche and Osaze no follow for team wey dem dey prepare for
worldcup, and coach steven keshi know say pipu go gbege am seriously on top the
mata,
na him make am prepare him self well well and he dey answer the questions
with swagger until one person ask am say the call wey he no call Uche na
because say the player refused to let keshi manage am.
The
report say Oga kesh first balance well for him chair, looked the plenty pipu
come ask for the name of the reporter wey ask am question, commot the gedegede
wey dey him throat come reply.‘’he
say before dem born those players for football mata, he don make him money, say
he no get the kain money wey den wan give am to take quench him hunger. Say
other coach fit dey do am o, but him Stephen Okechukwu Keshi, no person fit
roger am, nothing wey dem fit take make am fall mugu
No comments:
Post a Comment