Thursday, March 27, 2014

NO BE 2 O, NA 3 JETA DIEZANI DEY CRUISE- HOUSE OF REPS



As e dey go now, e be like say dem don dey warn members of the House of Representatives Committee on Public Accounts say make dem waka softly on top the investigation wey dem dey do into how Oga Minister of Petroleum Resources, Mrs. Diezani Alison-Madueke dey spend money like oyinbo Government.


Mata come still show say Madueke  no hire just 2 jets o, as per wetin dey the committee record, she charter another one wey make am 3. The committee wey Solomon Olamilekan dey lead dey try investigate how she take spend N10bn on top one Challenger 850 wey dem hire and dey maintained for personal use of the minister.

The PUNCH talk am on Wednesday say the committee never even start real meeting on top d mata when dem see another fresh information say Alison-Madueke even dey charter jet number two wey she take dey waka. One source yarn punch say a return trip on top the Global Express XRS to London for example, dey chop like €600,000 or N137m.

No comments: