House
of Representatives, on Thursday say make Federal Government try establish a
Judicial Commission of Enquiry wey go take eagle eye look into the mata of dem
kidnappers wey dem find for Soka area for Oluyole Local Government Area,Ibadan,
Oyo State.
They
say the commission go try know the facts wey dey behind the establishment and
operation of this horror film and go punish pipu wey dey sponsors that kain
criminal business
Na
him come make say the House command hin Committees on Human Rights, Police,
Public Safety and National Security to shine light for the matter and carry
report come give am within four weeks.
The
House also tell d Inspector General of Police say make him command him pipu
make dem come take over the area to preserve the material evidence wey dey on
ground.
Na
one motion wey Honourable Ibrahim Olaifa move say dem gats investigate the
matter, cos the mata na national tragedy and a calamity of monumental
proportion, therefore government musto do Something to take protect the lives
and dignity of its citizens.”

No comments:
Post a Comment