The
National Oga wey dey Coordinate Oodua People’s Congress (OPC), Chief Gani
Adams, who dey represent South-West for the confab wey dey shele for Abuja,
talk him mind on Thursday, say he too dey disappointed on top the threat wey the
Lamido of Adamawa, Alhaji Aliyu Lamido, dey yarn say him go lead him pipu
coomot from Naija go cameroun if dem no gree give dem wetin dem dey find.
Otunba
come say make Yoruba pipu dey shine dem eyes well well o, say any body wey come
represent dem for the conference and no dey do well, make dem make sure say na
kill dem kill him political career, make dem make am totally irrelevant.
He
dey yarn so wen he arrive from Abuja for Murtala Mohammed Airport, Gani Adams, say as per the Lamido of Adamawa, and the dust
wey he yarn say e for good make royal father wey big like am dey sabi pocket
dem tongue, he say no body get that kain right to dey threaten our unity for
naija cos na everybody for the six geo political zones get wetin dem dey find.

No comments:
Post a Comment